#dailyscripturalginger результаты поиска
"No de worry ursef. Trust Baba God, also trust me" -Jesus (c.f Jn 14:1) #DailyScripturalGinger #975 03.04.26
No de ever think se na only u or ur pipo weh Baba God dey for. Baba God dey for everybody. E no reserve Imsef for any tribe or culture. E de give di Holy Spirit and repentance even to pipo weh u no expect. (c.f Acts 11: 1-18) #DailyScripturalGinger #969 27.04.26
After di angel tell Mary how she go take born Jesus, Mary talk se "I be God servant, mek e be as God don talk." We supos learn from Mary as she take surrender to di will of God. (c.f Lk 1:38) #Annunciation #DailyScripturalGinger #936 25.03.26
Na Jesus be di light of life. Anybody weh believe Jesus, kon do wetin e talk, e no go dey for darkness. (c.f Jn 10:46) #DailyScripturalGinger #971 29.04.26
Stephen na di first disciple to die for di gospel. E no fear, e talk di truth as e be. E allow di Holy Spirit use am. And di Holy Spirit give am vision of Jesus and heaven before e die. (c.f Acts 7:51-59) #DailyScripturalGinger #962 21.04.26
No gree for anybody no mean say make you no follow peace with all men 😏😒 It’s Day 2 of 7 of pidgin voiceovers!💃🏾🥰 #DailyScripturalGinger with @CeeOkafor75447
Have you tried Jesus today? Handover everything to him and watch him transform everything that concerns you! He loves you, you know? Day4 of 7 days of Pidgin voiceovers #DailyScripturalGinger @CeeOkafor75447
Dem don de plan how dem go take arrest and kpai +Jesus. Dem don even put ransom for Jesus head. But dem no know se di death of +Jesus go bring salvation to God pipo weh de all ova di world. (c.f Jn 11:45-57). #DailyScripturalGinger #938 27.03.26
Taste and see that the Lord is good! Even the crowing cockerel testifies to it 😂😂😂 Day5of7 days of pidgin voiceovers #DailyScripturalGinger @CeeOkafor75447
"Upon even as He carry man flesh, He humble imsef in obedience to God reach di point weh e die" (c.f Phil 2:7). #DailyScripturalGinger #939 28.03.26
Count your blessings, name them one by one and it will surprise you what the Lord shall do! Happy Sunday fam!💃🏾💃🏾💃🏾💃🏾 Day7of7 days of Pidgin Voiceovers. Hallelujah!🔥💃🏾💃🏾 #DailyScripturalGinger @CeeOkafor75447
Love the Lord your God with all your heart and with all your soul and with all your mind! Day6of7 of Pidgin Voiceovers 💃🏾💃🏾💃🏾 #DailyScripturalGinger @CeeOkafor75447
Di members of di early church de always look out for each oda. Dem de share wetin dem get to everybody. Dis one na big challenge to us, mek we de look out for Christians weh no get, kon find way to help dem. (Acts 4:32-37) #DailyScripturalGinger #954 14.04.26
Let your light so shine that all men will see your good works! Be diligent in whatever your hands finds to do and you shall stand before kings! Na the work I carry for head like fishpie like this ooo Day 3 of 7 days of pidgin voiceovers #DailyScripturalGinger @CeeOkafor75447
Dey humble. Baba God no like proud pipo. (c.f 1 Peter 5:5b) #DailyScripturalGinger #967 25.04.26
+Jesus bin join Im two disciples as dem bin de waka go Emmaus, even wen dem bin no recognize am. Na so +Jesus de follow us waka anywhere we de go, even if we no recognize am. (c.f Lk 24:13-25) #DailyScripturalGinger #960 19.04.26
As di women hear di news of di resurrection, dem go go tell di disciples. (c.f Mt 28:8) As pipo weh don experience di power of di resurrection, we gats share dis joyful news wit odas. #EasterMonday #DailyScripturalGinger #947 06.04.26
U de suffer, but u still de run away from Jesus. Why nah? Jesus de talk se make u come. No matter di kyn sin weh u commit, no matter the kyn suffer weh u de suffer. Come to Jesus, u go find rest. (c.f Mt 11:28-30) #DailyScripturalGinger #471 11.12.24
+Jesus di Son of God give up im life bicos of di sins of di sons of men. If u dey grateful for wetin Jesus do, u gats die to sin, so dat u sef go fit live for God. (c.f Jn 19). #GoodFriday #DailyScripturalGinger #944 03.04.26
No be until Jesus appear to u like e appear to St Paul before u go change ur ways. Conversion na daily thing. Pray, mek God help u to carry di energy weh u de use do bad thing kon use am de work for God. (c.f Acts 9:1-20) #DailyScripturalGinger #966 24.04.26
"No de worry ursef. Trust Baba God, also trust me" -Jesus (c.f Jn 14:1) #DailyScripturalGinger #975 03.04.26
Na Jesus be di light of life. Anybody weh believe Jesus, kon do wetin e talk, e no go dey for darkness. (c.f Jn 10:46) #DailyScripturalGinger #971 29.04.26
No de ever think se na only u or ur pipo weh Baba God dey for. Baba God dey for everybody. E no reserve Imsef for any tribe or culture. E de give di Holy Spirit and repentance even to pipo weh u no expect. (c.f Acts 11: 1-18) #DailyScripturalGinger #969 27.04.26
Jesus talk se "I come so dat pipo go get life, di kyn life weh dem go live well well." (Jn 10:10b) U no fit get dis life if u no listen to di voice of Jesus and believe wetin e tok. #DailyScripturalGinger #968 26.04.26
Dey humble. Baba God no like proud pipo. (c.f 1 Peter 5:5b) #DailyScripturalGinger #967 25.04.26
No be until Jesus appear to u like e appear to St Paul before u go change ur ways. Conversion na daily thing. Pray, mek God help u to carry di energy weh u de use do bad thing kon use am de work for God. (c.f Acts 9:1-20) #DailyScripturalGinger #966 24.04.26
Stephen na di first disciple to die for di gospel. E no fear, e talk di truth as e be. E allow di Holy Spirit use am. And di Holy Spirit give am vision of Jesus and heaven before e die. (c.f Acts 7:51-59) #DailyScripturalGinger #962 21.04.26
Jesus tell some pipo weh kon meet am se dem de meet am bikos e de multiply food give dem. If u de meet Jesus only bikos of di material tins weh u go gain, den ur Christianity no deep. (c.f Jn 6:22-29) #DailyScripturalGinger #961 20.04.26
+Jesus bin join Im two disciples as dem bin de waka go Emmaus, even wen dem bin no recognize am. Na so +Jesus de follow us waka anywhere we de go, even if we no recognize am. (c.f Lk 24:13-25) #DailyScripturalGinger #960 19.04.26
Di Apostles bin dey happy bikos dem suffer for di name of Jesus. U nko? If u de suffer bikos u be Christian, how u go react? (c.f Acts 5:41) #DailyScripturalGinger #957 16.04.26
"Baba God love di pipo weh dey dis world so tey E kon send Im only Son, so dat anybody weh believe am, e no go die, but e go get eternal life." (Jn 3:16) #DailyScripturalGinger #955 15.04.26
Di members of di early church de always look out for each oda. Dem de share wetin dem get to everybody. Dis one na big challenge to us, mek we de look out for Christians weh no get, kon find way to help dem. (Acts 4:32-37) #DailyScripturalGinger #954 14.04.26
Omoh, to be born again no be just chochocho. U must continue to de kill sin weh de ur body, so dat ur spirit go dey alive inside Christ Jesus. Na daily something, no be one time thing. If u no born again, u no go fit enter heaven (c.f Jn 3:5) #DailyScripturalGinger #953 13.04.26
Omoh, to be born again no be just chochocho. U must continue to de kill sin weh de ur body, so dat ur spirit go dey alive inside Christ Jesus. Na daily something, no be one time. If u no born again, u no go fit enter heaven (c.f Jn 3:5) #DailyScripturalGinger #953 13.04.26
From far distance, John di beloved don sight Jesus and recognize Am immediately. Even wen di oda disciples come near, dem sef no quick know se na Jesus. E get as u go love Jesus, e no go hard u to recognize am. (c.f Jn 21:1-14) #DailyScripturalGinger #951 10.04.26
Wen Jesus appear to im disciples, e first tell dem "Peace be with u." Wen our hearts get doubt, wen trouble dey and we no get peace of mind, mek di peace of Jesus settle for our mind and heart. (c.f Lk 24:35-48) #DailyScripturalGinger #950 09.04.26
Di breaking of di Word de make our heart dey on fire. Di breaking of di bread (Eucharist), de open our eyes to see Jesus. Na so e be for di 2 disciples weh bin de waka go Emmaus. Na so e suppose be for us during mass. (c.f Lk 24:13-25) #DailyScripturalGinger #949 08.04.26
As di women hear di news of di resurrection, dem go go tell di disciples. (c.f Mt 28:8) As pipo weh don experience di power of di resurrection, we gats share dis joyful news wit odas. #EasterMonday #DailyScripturalGinger #947 06.04.26
Evriwia don quiet. E be like se hope no dey again. Death go feel se na im go reign foreva. But e no know se di darkest time of di night na just before daybreak. Dat stone weh cover di tomb go soon roll comot. (c.f Mt 27:57-60) #HolySaturday #DailyScripturalGinger #945 04.04.26
+Jesus di Son of God give up im life bicos of di sins of di sons of men. If u dey grateful for wetin Jesus do, u gats die to sin, so dat u sef go fit live for God. (c.f Jn 19). #GoodFriday #DailyScripturalGinger #944 03.04.26
Baba God turn Saul from 'Saul di persecutor' to 'Paul di preacher'. E no get anybody weh God no fit use. Mek Baba God change our bad energy to good one, so dat we sef go fit work for am. #Conversion_of_St_Paul (c.f Acts 22:3-16) #DailyScripturalGinger #520 25.01.25
Jesus na di sweetest heart. Na so so Love and mercy full im heart. Excess Love weh de burst brain❤🔥 Dat loving heart of Jesus de call u to God, e de call u to love. Feast of the Sacred Heart of Jesus #DailyScripturalGinger #287 07.06.24
After di angel tell Mary how she go take born Jesus, Mary talk se "I be God servant, mek e be as God don talk." We supos learn from Mary as she take surrender to di will of God. (c.f Lk 1:38) #Annunciation #DailyScripturalGinger #936 25.03.26
"We de beg u behalf of Christ, se mek u reconcile with God." (2 Cor 5:20) As u de put ash for head today, try repent. #Ash_Wednesday #DailyScripturalGinger #558 05.04.25
+Jesus di Son of God give up im life bicos of di sins of di sons of men. If u dey grateful for wetin Jesus do, u gats die to sin, so dat u sef go fit live for God. (c.f Jn 19). #GoodFriday #DailyScripturalGinger #944 03.04.26
Guy, If u don taya, Come to Jesus, na only Him fit give u beta rest. (c.f Mt 11:28) #DailyScripturalGinger #698 17.07.25
Im throne na cross! Im crown na thorns! Di kingship of Jesus no be like di kingship of dis world. Just like di gud thief, ur prayer supos be "Jesus, remember me wen u come into ur kingdom." (Lk 23:42) FeastOfChristTheKing #DailyScripturalGinger #831 23.11.25
Blind man no fit lead blind man! Follow who know road! (c.f Lk 6:39) #DailyScripturalGinger #555 02.03.25
Jesus still de call u mek u follow am. Even as u be sinner, e love u like dat. Just follow am and e go turn ur life around. (c.f Luke 5:1-11) #DailyScripturalGinger 17.03.26
Jesus enta synagogue read from prophet Isaiah to show us se Scripture dey important and na dia im mission de. E dey important to study Scripture weda as family or as individual. So dat we sef go know our mission for dis life. (c.f Lk 4:14-21) #DailyScripturalGinger #521 26.02.25
If u wan pray, no de talk plenty. No be by plenty talk weh Baba God go hear u. If u wan pray, pray wit di formula weh Jesus Christ teach in disciples... "Our Papa for heaven..." (Mt 6:7-15) #DailyScripturalGinger #662 19.06.25
One King, Jesus Christ, weh decide se e go die to save im pipo. #Palm Sunday #DailyScripturalGinger #939 29.03.26
U no fit claim say u love Jesus if u no de do wetin Him want. And u no fit sabi wetin him want if di Holy Spirit no teach u. My people make we continue to de pray so dat di Holy Spirit go dey our body. #Pentecost 🔥 #DailyScripturalGinger #651 08.06.2025
Di house of God na house of prayer. But now, e don turn place for killing and destruction. Pray for the Church in Nigeria! (c.f Lk 19:46) #DailyScripturalGinger #829 21.11.25
As di angel pass im message finish, Mary kon answer, "I be God servant, mek e be for me as God want am" Like Mary, mek we learn to gree for God. U no got gree for God if u no trust God. Annunciation of the Lord #DailyScripturalGinger #227 08.04.24
Evriwia don quiet. E be like se hope no dey again. Death go feel se na im go reign foreva. But e no know se di darkest time of di night na just before daybreak. Dat stone weh cover di tomb go soon roll comot. (c.f Mt 27:57-60) #HolySaturday #DailyScripturalGinger #945 04.04.26
Di breaking of di Word de make our heart dey on fire. Di breaking of di bread (Eucharist), de open our eyes to see Jesus. Na so e be for di 2 disciples weh bin de waka go Emmaus. Na so e suppose be for us during mass. (c.f Lk 24:13-25) #DailyScripturalGinger #949 08.04.26
Heart weh de pure. Heart weh de ponder di word of God. Heart weh de rejoice in God Heart weh too de love Heart weh de suffer because of her pikin suffering. Immaculate Heart of Mary! Pray for us! #DailyScripturalGinger #288 08.06.24
Omo, anytime e hard or e rough for u, just look di cross. Di cross de remind us of Baba God love for us. Anybody weh de look de cross with faith, e go get healing, salvation and eternal life. (c.f Jn 3:13-17) Exaltation of the Holy Cross #DailyScripturalGinger #385 14.09.24
U too special! Jesus fit reach any extent to save u. Na him de leave 99 sheep go find the 1 weh loss. But u sef suppose get sense. No de stray anyhow. Na God pikin u be, u no be goat. (c.f Lk 15:1-10) #DailyScripturalGinger #439 07.11.24
Something went wrong.
Something went wrong.
United States Trends
- 1. Jarrett Allen N/A
- 2. #euphoria N/A
- 3. #LetEmKnow N/A
- 4. Cavs N/A
- 5. #RHOA N/A
- 6. Rudy N/A
- 7. Max Strus N/A
- 8. Raptors N/A
- 9. Habs N/A
- 10. Donovan Mitchell N/A
- 11. #GoAvsGo N/A
- 12. Montreal N/A
- 13. Scottie Barnes N/A
- 14. #90DayFiance N/A
- 15. James Harden N/A
- 16. America's Mayor N/A
- 17. Lou Ann N/A
- 18. Lightning N/A
- 19. Makar N/A
- 20. GameStop N/A